Breaking News

Student tied and shot dead at UNIZIK

(Written in pidginAs e dey hot… just yesterday morning nah so dem open mouth, close eye take gun kii kii pesin. Wetin man no go hear for this life wey we dey?
Sunday , 30th of August 2015, we source yarn us say dem kpai one bobo for Columns Villa, Ifite. Im talk say dem bin dey do cha cha (gambling) for one guy room, situation kum change hand nah so the bobo dem disperse.College Student tied and shot at UNIZIK
The guy man wey get the room komot go im padi lodge nah so dem niggas kum enter im cabal make dem kpai am but nah another bobo bin dey. Dem tie the nigga, kum shoot am. Ewo! This one nah konfam human brutality.College Student tied and shot at UNIZIK
So the bobo wey dem shoot don die for another pesin? Hmm… this world nah rubbish place sha…
As e dey hot, make una dey careful oh and me still dey pray make bad thing no catch we people.
 Naijaown don yarn im mind… As e dey hot!
Make una add us on BBM for latest gist 56447169 

No comments